Di way dem dey bihave show sey wetin Moses rite for di law, dey dia heart and dia mind dey tell dem sey, “Dis tins dey rite and e go kondemn or free us from wetin wi do.”
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
May bi una dey tink sey wi dey tok dis tins to defend awasef. No! Wi dey tok to una like dis as Christ savant and na God bi awa witness. Evritin wey wi dey do, na to make una strong.
Na dis tins make God choose mi as prisha, apostle and tisha to Gentile pipol, so dat I go prish faith and wetin bi trut (na true word I dey tell una so, I nor dey lie).