So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
But nor-tin wey pipol use against una, go fit distroy una; una go ovakom evribody wey dey akuiz una. Dis na wetin pipol wey dey serve Mi dey enjoy and I go defend and make dem win.” Na so God tok!
But God wey strong and get pawa, dey my side. So doz wey dey plan against mi, go fail. Yu go disgrace dem forever, bikos dem nor go susid and dem nor go ever forget di disgrace.
Make una nor dey sturbon to God and make una nor fear di pipol wey dey di land, bikos dem bi like bread to us. God dey with us and E don defeat di gods wey dey protet dem; so make una nor fear.”
If God nor ponish us for di bad tins wey wi dey do, e mean sey God dey support us? No! So if God ponish us, wi go sey E dey wiked? (Na so some pipol dey tok).
Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”
Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”