Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 8:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 But if wi put hope for wetin wi nor fit si, wi go take all awa mind wait for am with patient.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 8:25
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, make yu dey patient, as yu dey wait for God and get strong mind. Yes! Make yu dey patient, as yu dey wait for am.


I dey kwayet dey wait, bikos na God dey diliver mi.


Wen all dis tins dey happen, pipol go sey, “Look! Make una si God for here! Wi wait for am and E don kom diliver us. Si God for here! Wi really wait for am. So make wi rijoice and dey happy bikos E don save us.”


My Oga God! Wi dey wait for Yu as Yu dey judge us. Yes! Na yor greatness and as Yu dey do yor tins, dey make us grow.


So, if una stand rish di end, God go save una.”


But di seeds wey fall for betta groun, na di pipol wey hear God word, hold am with betta mind, dey obey God and bear wahala, so dem kon bear plenty fruit.”


Make una let una hope give una happiness. Make una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray.


God go give life wey nor dey end to di pipol wey dey do good, wey wont glory, honor and long life.


Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us.


Wi still dey pray sey una go dey strong with God pawa wey get glory. Una go show sey una dey patient and get strong mind for God work with happiness.


Wi remember di work wey una don do thru faith and as una dey bear bikos of di hope wey una get about awa Oga God Jesus Christ.


I pray make God guide una heart to undastand en love more-more, so dat una go get Christ patient.


Una nid to dey patient, so dat una go fit do wetin God wont and den, una go receive en promise.


So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.


Bikos Abraham get patient, God kon gi-am wetin E promise am.


Mi John, I bi una broda and I dey follow una share from di trobol bikos of di kingdom and dey bear di sofa wey dey inside Jesus. Dem porshu mi go Patmos Island, bikos I dey prish God word and tok about Jesus Christ.


Anybody wey dem suppose to katch, dem go katch am. Anybody wey swod go kill, dem go kill-am with swod. So, God pipol must bear well-well and get faith.


Dis mean sey, God pipol go bear well-well, bikos dem dey obey en kommandment and get faith for Christ.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ