20 Bikos of sin, di world dey sofa from God curse naw and nor bi bikos dem wont am like dat. But di world dey hope
E koll di boy Noah kon sey, “Dis one go give us rest from all di hard-hard work wey wi dey do from dis groun wey Oga God don curse.”
So God kon tell Noah, “I don sey I go kill evritin wey dey dis eart, bikos bad tins full di eart bikos of dem. Naw I won distroy dem and di eart.
Si! Yu don make my life short well-well and my whole life bi like one sekond to Yu. True-true, evribody life just bi like breeze wey dey blow pass.”
Di tisha sey, “Evritin dey yuzles! Yes, evritin really dey yuzles!”
Dem don turn am to wildaness. Di land empty and dey yuzles to mi. Di whole land don turn desert and e nor koncern anybody.
Na how long awa land and di grass for di farm go dey dry? Awa animals and birds dey die, bikos of dis pipol wikedness! Pipol wey sey, ‘God nor dey si wetin wi dey do.’ ”
So di land go mourn, bikos evritin wey dey inside, go die. All di animals, birds and even fish, go die too.”
All di melu dey kry bikos dem dey hongry and grass nor dey for dem to chop. Even di sheep demsef dey sofa.
Wi know sey evritin wey God kreate, dey kry, just like di way woman wey won born dey kry.
Na dis hope save us. But if wi don already get wetin wi dey hope for, den wi nor nid to dey hope again. Abi who dey hope for wetin e don already get?