Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 8:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Since di Holy Spirit don give una life wey kom from Jesus Christ, e go free una from sin and deat.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 8:2
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make Yu give mi back di joy wey make mi dey save, so dat I go dey happy to obey Yu.


Wen di creatures move, di wheels go move too and wen dem stop to waka, di wheels go stop. Wen dem raiz komot groun, di wheels go raiz too, bikos dia spirit dey inside di wheels.


Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”


But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”


Na di Spirit go fit give pesin life; human being pawa nor fit do am. All dis word wey I dey tell una so, dem bi Spirit and dem dey give pesin life.


and una go know di trut and di trut go free una.”


So wen Man Pikin free una, una don dey free bi dat.


Make una salot Priscilla and Akwila for mi. Dem bi my ko-workers for awa Oga God Jesus Christ work,


So, wetin make us dey boast? Wi nor fit boast at-all! Why e bi like dis? Na bikos wi dey obey di law? No! Na bikos wi bilive Jesus Christ.


and as sin dey kontrol us thru deat, na so God grace dey rule thru raitiousness wey dey bring life wey nor dey end bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.


Sin nor go fit kontrol una, bikos una nor dey under di law again, but na God grace dey kontrol una naw.


And as e bi sey una don free from sin, una don bikom slave to good tins.


But naw, una don dey free from sin kon bi God savant. Dis go make una dey holy and God go give una life wey nor dey end.


So I si sey dis law dey work, bikos wen I won do good, na only bad tins dey enter my mind.


but inside mi, I kon undastand sey sometin dey fight against my mind and e dey make mi bi sin savant, bikos e dey kontrol my body.


So my brodas and sistas, na so e bi with una too. Una don bikom part for Jesus Christ body and una don die to di law pawa. Naw, una dey free to bi Christ own; di pesin wey God raiz from deat make una for dey serve am.


So, God nor go kondemn pipol wey bilive Jesus Christ.


Di first man na Adam and God word sey, “Dis Adam na pesin wey God kreate like us. But Jesus, wey bi di last Adam, na pesin wey dey give life to pipol.”


Na God bi di Spirit and anywhere en Spirit dey, pipol go dey free.


Na God make us fit do dem, so dat wi go serve di new kovenant; dis nor bi di law wey dem rite, but na di one wey koncern God Spirit, bikos di law wey dem rite dey bring deat, but di Spirit dey give life.


As for di law, I don die to am, so dat I go fit dey alive with God.


Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free.


Make una help karry each oda load and if una do like dis, una dey obey Christ.


But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do.


Afta di three and half days, God go breath life enter dia body and dem go wake-up! Fear go katch all doz wey dey look dem.


Den di angel show mi di river wey dey give life. Di river klear like crystal and e dey pour kom from God and di Lamb throne.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ