Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 8:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Evritin wey God kreate for dis world, dey wait for God to show en shidren to di world.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 8:19
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sey, “I go kreate new heavens and new eart. Nobody go remember di tins wey don happen before and e go komot from dia mind kpata-kpata.


But di time dey kom wen Israel pipol go plenty like san-san for sea wey nobody fit kount or measure. Aldo God dey sey, “Una nor bi my pipol,” but di day dey kom wen God go sey, “God wey nor dey die, na-im bi una papa!”


God go bless una wey dey make peace, pipol go koll una God shidren.


But evribody wey receive and bilive en name, e go give dem di rite to bi God pikin.


Dis Jesus Christ go stay for heaven till di time wey God go make evritin betta again as E don tok thru en holy profets.


Na doz wey God Spirit dey lead, bi God shidren.


Na God Spirit make us know sey wi bi God shidren.


I dey sure sey, wi nor go fit kompare all di sofa wey wi dey sofa naw, with di glory wey God go give us.


Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us.


For where God for tell dem sey, ‘Una nor bi my pipol, na der dem go for still koll dem “God shidren.” ’ ”


so una nor go miss any gift wey di Holy Spirit dey give, as una dey wait for di day wen God go bring awa Oga God Jesus Christ kom back.


God go help una rish di end, so dat E nor go si fault for una life for di day wen Jesus go kom back.


kon bi una Papa and una go bi my shidren.” Na so God wey get all di pawa, tok.


Bikos thru Jesus Christ, all of us don bikom God shidren by faith.


Di hope wey I get bi sey, shame nor go ever fit katch mi; my heart go strong well-well and as I dey do naw, na so I go always dey do. Evritin for my body go praiz Christ, weda I dey alive or I don die.


Wen Christ (wey bi una life) go kom, una go follow am kom with glory.


Dis mean sey di tins for eart go shake komot and na only di tins wey God nor won shake, go remain.


So, make una always dey ready for akshon. Make una shine una eye and put hope for di grace wey Jesus Christ go bring.


Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.


Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.


My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.


Di pesin wey win, go inherit dis tins. I go bi en God and e go bi my pikin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ