But di time dey kom wen Israel pipol go plenty like san-san for sea wey nobody fit kount or measure. Aldo God dey sey, “Una nor bi my pipol,” but di day dey kom wen God go sey, “God wey nor dey die, na-im bi una papa!”
Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us.
Na so too di Holy Spirit dey help us bikos wi dey weak. Bikos wi nor know wetin wi suppose to pray for, di Spirit by ensef dey kry beg God, for di way awa word nor go fit esplain.
Dis mean sey di pikin wey Abraham born (Hagar pikin, Ishmael) before God promise am, nor bi di one wey God choose. Instead, di pikin wey e born thru God promise, na dat one bi Abraham true pikin.
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
Make una nor do wetin go make di Holy Spirit vex. Bikos na di Holy Spirit bi di mark wey God put for una body, so dat for judgement day, E go know doz wey E go save.
Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.
Na like dis una go take know God and devil shidren. Pesin wey nor dey do wetin good for God eye and nor love en broda or sista for Christ, nor bi God pikin.
My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.
(Di pesin wey bilive God Pikin, go know inside ensef sey, dis tin na true, but pesin wey nor bilive God, dey sey God dey lie, bikos e nor bilive wetin God tok about en Pikin).