12 So my brodas and sistas, wi get work to do for God, so make wi nor live as awa body wont.
My God, I bi yor savant; yes, I bi yor savant wey dem born for yor house and Yu don free mi from di shains kon save mi from deat.
forgive us all di bad-bad tins wey wi don do, as wisef dey forgive odas di bad tins wey dem do us.
If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.
Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life.