Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 7:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Tank God! Jesus Christ don save mi. So, I go obey God law with my mind, even doh sin pawa still dey inside mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 7:25
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For dat time yu go sey: “Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi, but naw, Yu dey konfort mi and Yu nor dey vex again.


So heavens make una shaut for joy! Eart, make una shaut dey happy! Make di mountins bigin sing, bikos God go konfort en pipol kon sorry for di ones wey dey sofa.


I go tell doz wey dey prison sey, ‘Make una kom out!’ And doz wey dey for darkness, ‘Make una kom enter lite!’ Dem go bi like sheep wey dey chop grass for hill.


E go born boy and yu go koll am ‘Jesus,’ bikos e go save en pipol from dia sin.”


Sin nor go fit kontrol una, bikos una nor dey under di law again, but na God grace dey kontrol una naw.


But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.


Since di Holy Spirit don give una life wey kom from Jesus Christ, e go free una from sin and deat.


So, make wi tank God wey give us viktory thru awa Oga God Jesus Christ.


Na dis make us dey tank God for dis gift wey pesin mout nor fit tok.


With awa Oga God Jesus Christ name, make una dey tank God awa papa for each oda.


Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.


Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.


For anytin wey una dey do, weda una dey tok or do oda tins, make una do am with awa Oga God Jesus Christ name and tank God thru am.


So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ