Wen yor pipol sin against Yu (bikos e nor get who nor dey sin) and Yu vex kon let dia enemies defeat and karry dem like prisonas go anoda land. Even if di land far well-well,
I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.
Anytin wey yu bilive about dis matter, make yu keep am to yorsef and God wey dey heaven, dey si am. God don bless di pesin wey nor kondemn ensef, bikos of wetin e do.
Make una help odas make dem nor enter hell-fire, so dat una go fit save dem and as una dey help odas, make una dey fear God kon hate di tins wey go make una sin.