Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 7:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 But di law dey holy, rite and good.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 7:12
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu kom down from heaven kon tok to dem for Mount Sinai; Yu give dem betta judgement, laws, korrect tishings and kommands.


True-true, I love yor kommand pass gold and I even love am pass di gold wey fine pass.


My God, na Yu bi my raitiousness and yor laws good well-well.


I don test yor promise well-well kon si sey dem dey pure and dat na why I always dey love dem.


Make my tongue sing about yor word, bikos all yor kommandment dey rite.


Make Yu tell mi again about yor promise wey Yu make to di pipol wey dey fear and obey Yu.


But all yor kommand dey good, so make Yu protet mi from di pipol wey just like to kill mi.


Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.


So make wi trowey di law bikos of faith? No way! E nor go work! Instead, wi go make di law strong well-well.


Wi know sey di law dey spiritual. But I bi human being and dem don sell mi give sin.


Since I dey do wetin I hate to do, e show sey di law dey korrect.


Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.


Na wish oda great kountry get rules and law like di ones wey I tell una today?


But wi know sey di law dey good wen pipol dey obey am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ