Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 6:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Wi know sey di pesin wey wi bi before, dem don nail am for cross with Jesus. So awa body nor bi sin savant again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 6:6
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Naaman sey, “Since yu nor gri take anytin, abeg make yu give us two donkey wey wi go use take pak una san go awa land, bikos I nor go ever offa any ofrin give any oda god escept yor God.


Oga God, difren-difren pipol don rule us, but na only Yu wi go dey praiz forever.


Derfor, make una nor allow sin kontrol una body again, so dat una nor go dey do bad tins.


But naw, una don dey free from sin kon bi God savant. Dis go make una dey holy and God go give una life wey nor dey end.


Wi know sey di law dey spiritual. But I bi human being and dem don sell mi give sin.


Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life.


Bikos na Christ love dey kontrol us since wi know sey, Christ die for evribody; so evribody don die.


I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.


Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do.


I nor go boast about anytin escept for di sofa wey awa Oga God Jesus Christ sofa and bikos of dat sofa, di world nor mean anytin to mi and I don die to di world too.


Koncerning di kind life wey una dey live before, wi sey make una trowey dat bad spirit wey dey make una do bad-bad tins


So make una kill evry bad karata wey dis world dey bring: Like to dey sleep with pesin wey una nor marry; dey bihave anyhow; follow dis world tins; dey do bad tins; long-trot and to serve juju.


Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ