Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 6:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 So wetin una gain from all doz bad tins wey una do? Na shame and deat doz tins dey bring.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 6:21
46 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Solomon tell Priest Abiatar, “Make yu dey go yor kountry for Anatot. Yu suppose to die, but I nor go kill yu naw, bikos na yu kare for di Kovenant Box wen yu dey with David my papa and yu follow am face all en trobols.”


I sey, My Oga God, I dey shame to raiz my head for yor front. Awa sins high pass awa head; dem even high rish heaven.


Di pesin go sing give odas sey, ‘I sin kon do wetin dey bad, but God nor ponish mi as e suppose to bi.’


“True-true, I dey tok like fool since, wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again.


So I dey shame, bikos of all wetin I don tok and I go pak dust for my head to take show sey I dey sorry for all wetin I tok.”


Den I enter inside di temple go ask my God and E show mi en plans for wiked pipol.


So, una go get wetin fit una and wetin una do, go make una sick.


Wetin pesin dey do fit dey korrect for en eye, but e dey lead am to en grave.


Wetin pesin dey do, fit dey good for en eye, but na deat dey end am.


So make una tell innocent pipol sey e go betta for dem, bikos God go reward dem for wetin dem don do.


My pipol go plant korn, but na grass dem go gada. Even doh dem work hard, nor-tin go show sey dem work, bikos I dey vex for dem, so dia food wey dem plant, nor go grow.”


Na mi wey bi God dey si and test human being heart. I dey trit each pesin akordin to how e dey live en life and wetin e dey do.


Bikos of dis, God nor allow rain fall, even for di rite time. With all dis tins, una still dey live una ashawo life and shame nor dey katch una.


Before, wi sin against Yu, but naw, wi wons turn from sin kom meet Yu. Afta Yu ponish us, shame nor let us karry awa head up again. Di sin wey wi sin wen wi dey yong, dey make us dey shame.”


Dem dey shame sey dem do dis kind wiked tins? ‘No!’ Dem nor dey shame at-all; dem nor even sabi form sef! Bikos of dis, just as pipol wey don die, na so too dem go die finish afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.


Den, if shame don katch dem for wetin dem do, make yu tish dem about di temple plan: how en design bi; di door-mot; en shape; as dem take arrange evritin for der and all en rules and laws. Rite evritin give dem, so dat dem go fit read how dem arrange di temple kon do di rules and obey di laws.


Many pipol wey don die go raiz; doz wey dey holy go get life wey nor dey end, while odas go sofa forever.


Aldo dem know sey God law sey, pipol wey dey live like dat go die, yet dem nor only dey do dis tins, but dem even dey support pipol wey dey do am.


Na thru one man sin enter dis world and deat kom thru sin. So wi must die, bikos evribody don sin.


Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life.


Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.


Wen wi still dey di world, di law dey make us do bad tins wey awa body wont and all dis tins dey bring deat.


Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life.


If wi let sin rule awa mind, wi go die. But if na di Spirit dey rule us, wi go get life and peace.


But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.


Naw, make una si wetin dis vexnashon wey God plan don do for una: Si how una work for God bi naw; si how una won show sey una hand klean; si as una dey vex bikos of di bad tin wey happen; si how una dey sopraiz; si as una dey won si and worry about us; si how una ready to ponish anybody wey do bad! For evritin, una don show sey una hand klean for dis matter.


But make una nor ever kill pesin, bikos of wetin one pesin tok. Two or three pesin must tok di same tin, before una go fit stone pesin die.


If pesin do wetin go make dem kill-am and dem hang am for tree make e die,


Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.


If pipol wey nor dey obey Man Pikin; dey take di kovenant blood make yeye and dey curse di Spirit wey bring grace, na how dia own ponishment go big rish?


But if na so-so shuku-shuku and grass di groun dey bear, dat mean sey e dey yuzles. So God go curse and distroy am with fire.


Wen di bad tins wey e won do, don mature, e go make am sin and wen sin don grow well-well, e go kause deat.


make yu know sey, di pesin wey bring yu wey bi sina kom back from di bad way, don save yor soul from deat and e don make Christ forgive yu all yor sins.


Di time for judgement don rish and e go start with God pipol. And if e start with us, wetin go happen to pipol wey nor dey obey God?


Naw my shidren, make una stay inside am, so dat wen E kom, awa heart go dey strong well-well and shame nor go make us run from where E dey.


Bikos dis pipol kill yor pipol and profets, so yu don give dem blood make dem drink, bikos na wetin good for dem bi dat!”


Den dem trow deat and grave inside di fire. Dis fire na di sekond deat.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ