Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 6:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 6:16
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Nor bi true sey if yu do wetin dey write, body go sweet yu? But if yu nor do wetin dey write, dat mean sey sin dey knock for yor door, bikos e won rule yu, but make yu nor allow am.”


E kon tell dem, ‘Make una go work for my farm, I go pay una well.’


“Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.


Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una, anybody wey dey kommit sin, na sin bi di masta wey dey rule am.


God nor rijet en pipol wey E choose from di biginnin. Dem rite for God word about how Elijah beg God for Israel pipol sey,


My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.


But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.


Una nor know sey una bi God Temple and en Spirit dey inside una?


E nor good make una dey boast! Una nor know sey, small yist wey dem put for bread, na-im dey make di whole bread raiz?


Una nor know sey na God pipol go judge di world? And if na una go judge di world, una nor fit setol small-small matter among unasef?


Una nor know sey wi go judge angels? Since na so, den wi suppose to judge di tins wey dey dis world!


Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;


Una nor know sey doz wey dey work for di temple dey chop food wey pipol bring kon give God for der? Abi una nor know sey pesin wey dey serve for altar na from der e for dey chop?


Una nor know sey, wen pipol dey run, na only one pesin go win di race and di prize? So make una run, so dat una go fit win!


If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”


Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ