13 Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.
Make una nor dey sturbon like una papa, but make una obey God as una dey kom en house wey E don make holy forever. Make una serve am forever, so dat E nor go vex for una.
Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.
Nebukadnezzar kon sey, “I praiz Shadrak, Meshak and Abednego God, bikos na-im send en angel kom diliver en savants wey trust am. Dem nor gri obey di king kommand! Instead make dem bow woship my god, dem risk dia life kon sey, ‘Na only awa God wi go woship.’
“I tell una true word, di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end.
Wetin full dia mind na wikedness, evil tins, long-trot, bad belle, bad-bad tins; jealousy, to kill and fight, to lie, to keep enemy with pipol, to judge pipol waka,
My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.
(I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont.
Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;
Di tins wey wi take dey fight, nor bi dis world own, but na God make am strong, so dat wi go fit skata all di strong place where wiked pipol dey. Wi dey skata trobol;
Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey: “Wake-up; yu wey dey sleep! Make yu raiz from grave and Christ go shine for yor life!”
Di hope wey I get bi sey, shame nor go ever fit katch mi; my heart go strong well-well and as I dey do naw, na so I go always dey do. Evritin for my body go praiz Christ, weda I dey alive or I don die.
So make una kill evry bad karata wey dis world dey bring: Like to dey sleep with pesin wey una nor marry; dey bihave anyhow; follow dis world tins; dey do bad tins; long-trot and to serve juju.
Make yu do evritin wey yu fit do, so dat God go si yu as betta pesin. Dey do yor work well as pesin wey nor dey shame, but dey ready to esplain God word wey bi trut.
But if wi konfess awa sin to am, e go forgive us kon wosh evritin wey nor good for God eye komot from awa life, bikos Christ dey always do wetin e sey e go do, since e dey raitious.