Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 6:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Derfor, make una nor allow sin kontrol una body again, so dat una nor go dey do bad tins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 6:12
35 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Nor bi true sey if yu do wetin dey write, body go sweet yu? But if yu nor do wetin dey write, dat mean sey sin dey knock for yor door, bikos e won rule yu, but make yu nor allow am.”


Make yor words guide my step, so dat I nor go waka enter evil.


Make Yu nor let mi do anytin wey nor good for yor eye and nor let sin kontrol mi. Den I go dey innocent and I nor go sin again.


“If man nor get hair for back of en head, e dey klean.


But if una nor drive di pipol komot, den dem go dey give una problem and dem go trobol una for di land.


Instead, make una wear Jesus Christ like klot for body. Den wi nor go do di tins wey awa body wont.


But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins.


and as sin dey kontrol us thru deat, na so God grace dey rule thru raitiousness wey dey bring life wey nor dey end bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.


Sin nor go fit kontrol una, bikos una nor dey under di law again, but na God grace dey kontrol una naw.


Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life.


If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.


Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life.


Dem always dey won kill wi wey dey alive bikos of Jesus Christ, so dat dem go si Jesus life for awa ordinary body.


Wi dey struggol as wi dey dis awa body. Wi dey karry heavy load, bikos wi nor won remove di klot wey bi awa body, but wi won wear heaven own join am, so dat life go swallow dis awa body wey fit die.


I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont.


Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do.


All of us dey live dis kind life before. Wi dey do difren tins wey awa body and mind wont. Dat time, wi bi shidren wey God won ponish like oda sinnas.


Koncerning di kind life wey una dey live before, wi sey make una trowey dat bad spirit wey dey make una do bad-bad tins


Wen di Oga una God don give dis kountry to una and una don konker dem, una must distroy dem finish. Make una nor enter agriment with dem.


nor bi to dey follow who yu nor marry, just as Gentile pipol wey nor know God dey do.


Make yu run from doz tins wey dey hongry yong pipol to do, so dat yu go please God forever. Den yu go fit love and stay for peace with odas wey dey serve God with klean heart.


Di grace dey tish us sey, make wi nor live like pipol wey nor know God or dey bihave anyhow. So make wi dey kontrol awasef; dey do good and follow God for dis time wey wi dey so,


Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.


Like shidren wey dey obey, make una stop di bad tins wey una dey do wen una neva know di trut.


My friends, I dey beg una, since una bi strenjas for dis world, make una nor follow di tins wey pipol like to do, bikos dem dey distroy pesin soul.


Dis pipol dey komplain waka and dey find fault. Dem dey go anywhere wey dia body karry dem go and dem dey boast. Dem dey tok wetin pipol like to hear, so dat odas go praiz dem.


Dem sey, “For di time wen dis world won end, some pipol go dey laf una and di tins wey God hate wey dey hongry dem to do, naim go dey push dem.”


For dat time, I tell una sey, if una disobey mi, I nor go drive di pipol wey dey stay for una land komot again. Dem go bi wahala to una and dia god go dey sweet una to serve.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ