But dis tins wey dem rite so, na make una for bilive sey na Jesus bi di Christ and naim bi Man Pikin and if una bilive am, una go get life thru en name.
Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.
So my brodas and sistas, na so e bi with una too. Una don bikom part for Jesus Christ body and una don die to di law pawa. Naw, una dey free to bi Christ own; di pesin wey God raiz from deat make una for dey serve am.
But naw, wi don free from di law. Wi bi like deat body and di law nor get pawa for awa body again. Naw wi suppose to serve God with di new life wey di Spirit dey give, nor bi di old life, wey bi to obey di law wey pesin rite.
So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.
Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!