Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us.
bikos of di work wey di broda dey do, di church don choose am as di pesin wey go dey follow us travel as wi dey give dis good gift, so dat all di glory go bi God own and dis go show sey wi dey ready to help.
Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.