Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 5:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Wi bi God enemies before, but E don make us en friends thru en Pikin deat. Naw, since wi don bi God friends, E go save us thru di life wey en pikin get.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 5:10
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So di priest kill di goats, put dia blood for di altar as sin ofrin to klean Israel pipol, bikos di king don tok am sey di burnt sakrifice and di sin ofrin, na for Israel pipol.


For di sevent day for di mont, yu go do di same tin for di pipol wey sin and dem nor know sey dem sin. Like dis, yu dey make di temple dey holy.


“God don set seventy weeks as di time wen E go take free yor pipol kon ribuild en temple. Una dey sofa, bikos of all di evil and wiked tins wey una do. Afta, E go forgive una sins and judge una well forever, so dat wetin E tok, go happen. Den E go anoint di holy temple again.


But if dem karry di blood enter God Temple kon use am as sakrifice to remove sin, dem nor go chop di animal at-all; dem must burn am finish.’ ”


Afta sometaim, di pipol for dis world nor go si mi, but una go si mi and bikos I dey alive, una go dey alive too.


Bikos as di Papa get life for inside am, na so e give en pikin life too.


Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”


Na my Papa wey dey for heaven send mi and as I dey for dis life bikos of am, na so di pesin wey chop my flesh go get life, bikos of mi.


As e bi sey Jew pipol rijet God word, dem don turn to God enemy, bikos of una wey bi Gentile pipol. But as God wont am, dem bi pipol wey E love, bikos of dia grand-grand papa dem.


Nor bi only dis won make us dey happy, but wi still dey happy bikos of wetin God don do thru awa Oga God Jesus Christ wey make us bi God friends.


For di time wen wi nor fit help awasef, Christ kon die for us wey bi sinnas.


True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge!


Who bi di pesin wey go kondemn us? Na Jesus Christ wey die for us; di pesin wey God raiz from deat and naw, e dey for God rite hand side dey pray for us.


Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.


Wi dey ripresent Christ, so dat God go tok to una, thru us. Wi dey beg una bikos of Christ sey, “Make una shange kon bi God friend!”


Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.


E use di sofa wey e sofa for cross take end dia kworel kon make dem one body as dem dey serve God.


All of us dey live dis kind life before. Wi dey do difren tins wey awa body and mind wont. Dat time, wi bi shidren wey God won ponish like oda sinnas.


So God make Christ like us wey bi en brodas and sistas. Like dis, Christ go sorry for us kon bi awa good High Priest. And bikos Christ dey koncern about God matter, e sakrifice ensef to remove awa sins.


So, di pipol wey Jesus take go meet God, e go save dem for forever and ever, bikos e dey alive to pray for dem.


(My shidren, I dey rite about dis matter, so dat una nor go dey sin.) But if anybody sin, wi get pesin wey dey beg di Papa for us, dat pesin, na Jesus Christ wey dey raitious


Na dis bi love: nor bi sey wi first love God, but na-im first love us wen E send en Pikin kom die for us as sakrifice wey make am forgive us awa sins.


di One wey dey alive! I die before, but naw, I dey alive forever and ever. Deat and grave key dey my hand.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ