6 David tok di same tin wen e tok about di blessing wey pesin dey get wen God don asept am, even doh dem nor deserve dat kind blessing. David still sey,
But nor-tin wey pipol use against una, go fit distroy una; una go ovakom evribody wey dey akuiz una. Dis na wetin pipol wey dey serve Mi dey enjoy and I go defend and make dem win.” Na so God tok!
“God don set seventy weeks as di time wen E go take free yor pipol kon ribuild en temple. Una dey sofa, bikos of all di evil and wiked tins wey una do. Afta, E go forgive una sins and judge una well forever, so dat wetin E tok, go happen. Den E go anoint di holy temple again.
Bikos na di Gospel dey show how God dey take make pipol klean for en eye. From di biginnin go rish di end, God sey, “Na only faith go make pesin dey klean for my eye.”
But leta, dem sekonsaiz am. Dis sign show sey, bikos of en faith, God don si am as raitious pesin, so dat e go bi papa to evribody wey bilive God, pipol wey God don asept, even doh dem neva sekonsaiz.
Dis blessing wey David dey tok about so, na only Jew pipol e tok am for, bikos dem sekonsaiz dem? No! Na still for Gentile pipol wey dem nor sekonsaiz. Bikos wi read for God word sey, “Abraham bilive God and bikos of en faith, God kon asept am as raitious pesin.”
Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”
kon bi one with am. My raitiousness nor kom from di law, but I dey raitious thru my faith for Christ. Bikos na thru faith God take make us dey raitious with am.
Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.
Na mi Pita wey bi Jesus Christ savant and apostle, rite dis leta to di pipol wey get di same faith wey wi get. God give una dis faith, bikos of en raitiousness wey kom thru awa Oga God and Savior, Jesus Christ.