22 Na dis make God koll am raitious pesin.
Abram bilive God and bikos of en strong faith, God kon koll am raitious man.
Wetin dem rite for God word? “Abraham bilive God thru faith and God kon si am as raitious pesin.”
David tok di same tin wen e tok about di blessing wey pesin dey get wen God don asept am, even doh dem nor deserve dat kind blessing. David still sey,