Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 4:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Di law dey bring God vexnashon, bikos where sin nor dey, law nor go dey.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 4:15
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Make una go meet and ask God for mi and Judah pipol. Make una find out wetin di words for di book mean. God don dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor gri obey wetin dey dis book at-all.”


So make una wear sak klot, kry and roll for groun, bikos God still dey vex well-well for Judah.


Just as dem dey invite pesin for party, na so too Yu invite my enemies and I kon dey fear. For di day wey God dey vex, nobody go fit eskape or survive am. Naw, my enemies don kill all di shidren wey I born and train.


Dem go trowey dia gold and silva for di street like sey na dirty, bikos gold or silva nor go fit save dem wen God vexnashon go kom and dem nor go fit use am get wetin dem wont or chop am like food and na dis gold and silva make dem sin.


Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.


“Naw si, una don dey won bihave like una papa wey like sin. Una wont make God vex for Israel pipol again.


If to sey I nor kom tok to dem, dem for nor dey guilty for dia sin. But naw, dem nor get any eskuse for dia sin.


Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”


Bikos na di Gospel dey show how God dey take make pipol klean for en eye. From di biginnin go rish di end, God sey, “Na only faith go make pesin dey klean for my eye.”


Sin dey di world before di law kom, but if law nor dey, wi nor go fit judge pipol sin.


Na sin dey make deat win and na di law dey kause sin.


Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.”


Na awa sin make law dey and na so e go bi, until di pikin wey God promise, go kom and na thru angels, God take give us di law thru en profet.


Make una nor let anybody deceive una with yeye word, na dis tins make God dey vex for doz wey nor dey obey am.


Na dis tins dey make God vex for doz wey nor dey obey am.


Evribody wey dey like to sin, nor dey obey God law and to sin, na to disobey God law.


One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ