Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 4:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Wen God promise Abraham and en shidren sey dem go inherit di whole world, E do am, nor bi bikos Abraham dey obey di law, but bikos e bilive God and God si am as raitious pesin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 4:13
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go bless doz wey bless yu, but doz wey curse yu, I go curse dem too. All di family for dis eart, go get blessing, bikos of yor name.”


I go bless am and I go make am born boy for yu. I go bless am and Sarah go bi plenty pipol mama and kings go dey among en shidren-shidren.”


Yor shidren-shidren go plenty like san-san for groun and dem go skata go west, east, nort and sout. I go bless all di family for di world with yu and shidren-shidren name.


Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.


Make yu ask mi, and di pipol wey dey dis world, I go give dem to yu as yor propaty and evriwhere for di world, go bi yor own too.


All di kings go bow for am and all di nashons go serve am.


And wi dey tell una di Good News about dis tins wey God promise awa grand-grand papa dem.


Doz wey don sekonsaiz, na Abraham bi dia papa and dia faith bi like en own, afta dem sekonsaiz am.


Dis mean sey di pikin wey Abraham born (Hagar pikin, Ishmael) before God promise am, nor bi di one wey God choose. Instead, di pikin wey e born thru God promise, na dat one bi Abraham true pikin.


And if e bi sey una bilong to Christ, den una bi Abraham shidren and pipol wey go inherit wetin God promise.


Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.


But Melkizedek wey nor even rilate to Levi pipol, still kollect one out of evry ten tins from Abraham, den e kon bless Abraham wey God don promise.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ