Make una tink of Abraham, una grand-grand papa and Sarah wey born una. Wen I koll Abraham, e nor get pikin, but I bless and gi-am shidren kon make en shidren-shidren, plenty.
Naw, make una bear fruit wey go show sey una don really turn from sin kom meet God, make una nor start to sey, ‘Abraham na awa papa.’ Bikos God fit take dis stones wey dey for groun take make pikin for Abraham!
So my brodas, wey bi Abraham shidren and una wey bi Gentile pipol wey dey fear God, na di message about how God go take save pipol, naim wi kom tell una so.
If God nor ponish us for di bad tins wey wi dey do, e mean sey God dey support us? No! So if God ponish us, wi go sey E dey wiked? (Na so some pipol dey tok).
Na dis one make God promise dey kom by faith and wi dey get am thru favor. Nor bi only pipol wey dey obey di law bi Abraham shidren, but pipol wey bilive God like Abraham, naim en shidren dem bi too, bikos na Abraham bi awa spiritual papa.
Dis mean sey di law nor good? No! But na di law make mi know wetin sin bi. If to sey di law nor sey, “Nor get long-trot for anoda man tin,” I nor for know sey I nor suppose to do dat kind tin.
Na Hibru pipol dem bi? Misef na Hibru pesin too. Dem bi Israel pipol? Mi na Israel pesin too. Na Abraham bi dia grand-grand papa? Na dat same Abraham bi my grand-grand papa too.