6 Wi nor fit tok so at-all! If God nor dey rite, na how E go kon take judge di world?
I know sey Yu nor go do dat kind tin. Yu nor go kill pipol wey dey good with di bad ones.”
Abi God nor dey like justice? Abi God nor dey do wetin dey rite?
Make di heaven tok about how E take dey judge bikos na God go judge by ensef. Make di heavens tok about en good judgement, bikos na God bi di judge.
E go judge di world well kon rule di pipol with betta mind.
before God, bikos E dey kom! Yes, E dey kom judge di eart. E go judge di world well-well and E go judge evribody akordin to wetin dem do.
before awa Oga God, bikos E dey kom judge di whole world. E go judge di whole world well kon judge evribody, with raitiousness.
E go kom distroy all dis tenant, den give di grape farm to new tenants.” Wen di pipol hear dis, dem kon sey, “Make dis tin nor happen o-o!”
bikos E don choose one day wey E go take judge di world with raitiousness thru di man wey E choose and show evribody wen E raiz am from deat.”
So just as I prish give una, na so e go bi for dat day, wen God go judge all di sekret tins wey dey pipol heart thru Jesus Christ wey bi en pikin.
So make wi trowey di law bikos of faith? No way! E nor go work! Instead, wi go make di law strong well-well.
Even doh evry human being dey lie, God nor fit lie. God word sey: “Make yu dey tok wetin bi trut; so dat yu go fit win yor kase wen dem dey judge yu.”