31 So make wi trowey di law bikos of faith? No way! E nor go work! Instead, wi go make di law strong well-well.
E don rish time wey God go take akshon, bikos dis wiked pipol dey break en laws.
‘My God, I won do wetin Yu wont, bikos Yu rite yor laws for my heart.’ ”
God wont make dem know how E dey judge thru en raitiousness and how E dey show am.
den e nor nid to respet en papa again.’ Bikos of una tradishon, una don make God word yeye.
Jesus ansa, “Make e bi so naw, e betta make wi do evritin wey God wont.” So, John kon baptize am.
“Make una nor tink sey I kom spoil Moses Law and di tins wey di profets tish. Nor bi so, misef kom obey dem.
I tell yu di trut, if di good wey yu do, nor betta pass wetin di Farisee and di pipol wey dey tish di Law do, yu nor go fit enter God Kingdom.”
E go kom distroy all dis tenant, den give di grape farm to new tenants.” Wen di pipol hear dis, dem kon sey, “Make dis tin nor happen o-o!”
Since Jesus Christ kom, di law nor get pawa again and anybody wey bilive God, go dey raitious.
and yu dey tish foolish pipol and small shidren wey nor know anytin, bikos yu know sey, di trut and evritin wey man nid to know, dey for di law.
Even doh evry human being dey lie, God nor fit lie. God word sey: “Make yu dey tok wetin bi trut; so dat yu go fit win yor kase wen dem dey judge yu.”
Wi nor fit tok so at-all! If God nor dey rite, na how E go kon take judge di world?
If God promise na for only doz wey dey obey di law, den faith nor mean anytin and God promise go dey yuzles.
I dey like to obey God law with my whole mind,
Tank God! Jesus Christ don save mi. So, I go obey God law with my mind, even doh sin pawa still dey inside mi.
God do so, so dat wetin di law tok, go happen wen wi obey di Spirit, instead of awa own mind.
And wen I dey with pipol wey nor dey live by di law, I nor dey use di law for dem, so dat I go fit win dem. But dat nor mean sey, I go forget God law, bikos na Christ law dey rule mi.
As for di law, I don die to am, so dat I go fit dey alive with God.
I nor go trowey God grace; bikos if na wetin di law tok go make pesin good, den Christ die for nor-tin!