Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 3:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. But na thru di law, wi take know wetin sin mean.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 3:20
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God nor even bilive en own angels, bikos dem nor klean rish for en eye,


If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu?


Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.


True am, evribody wey bilive, go dey free from evritin wey Moses Law nor fit free dem from.


Bikos yu dey hear di law nor mean sey yu good for God eye, but na wen yu do wetin di law tok.


So, na thru faith pesin go dey rite with God, nor bi as e obey di law rish.


Wen God promise Abraham and en shidren sey dem go inherit di whole world, E do am, nor bi bikos Abraham dey obey di law, but bikos e bilive God and God si am as raitious pesin.


Di law dey bring God vexnashon, bikos where sin nor dey, law nor go dey.


Sin dey di world before di law kom, but if law nor dey, wi nor go fit judge pipol sin.


Di law kom so dat sin go inkrease, but where sin get pawa, God grace strong pass am


Since sin pawa use di law deceive mi, I kon die.


Why dem nor fit do am? Na bikos dem dey try to do good like sey na by work, nor bi with faith. Na dis make dem dey struggol kon dey fall on-top stone.


Na sin dey make deat win and na di law dey kause sin.


Wi know sey nobody dey free from God judgement, bikos na so di law tok and pipol go only dey free, if dem get faith for Christ. Since wi don bilive Christ, wi suppose to dey do good thru di faith wey wi get for Christ and nor bi to dey do wetin di law tok and wi nor go dey free from judgement, wen wi do only wetin di law tok.


As for di law, I don die to am, so dat I go fit dey alive with God.


Pipol wey wont make pipol know sey dem dey good, bikos dem dey keep di law, dem don already fall komot from God grace.


bikos di law nor fit make anytin dey pafet. But naw, wi get betta hope wey go draw us near God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ