Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 3:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 E really dey good to sekonsaiz pesin! And wi know sey na Jew pipol God first give en message.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 3:2
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I don test yor promise well-well kon si sey dem dey pure and dat na why I always dey love dem.


Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.


“But I go first tell yu wetin dem rite for di book wey yu fit trust. (Nobody fit help mi against di prince, escept Mikael wey dey guide Israel.


Una dey read God word well-well, bikos una bilive sey na wetin una read, go give una life wey nor dey end and na dis same word dey tok about mi,


Na dis same man dey with di pipol for wildaness; with di angel wey tok to am for Mount Sinai; with awa grand-grand papa dem and e kon receive God word for una.


Na dis gospel God promise us for en Holy Book thru en profets sey,


yu know wetin God wont make yu do and yu don learn how to do good tins, bikos yu know di law.


How Jew pipol take betta pass Gentile pipol sef? Or betta tin dey bikos dem sekonsaiz pesin?


But wot if some for dem nor gri bilive? Dat mean sey God dey lie?


wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise.


If I prish bikos I wont prish, dem go pay mi, but even if I nor wont prish, di prishin na wetin God send mi kom do.


So, bikos of Christ, God dey turn di world from en enemy, to en friend. E nor dey kount pipol sins against dem and E don give us di message wey go make pipol bi en friend.


But dem kon si sey na God sey make I prish en word to pipol wey dem nor sekonsaiz, just as E sey make Pita prish to doz wey dem sekonsaiz,


Timoti, make yu guide wetin God give yu well-well. Nor put yor mout for yeye tins or matter wey pipol wey nor know God dey tok and do, bikos dem dey oppoz yu with wetin dem feel sey dem know.


E don tey wen una bi Christian, so by naw, una suppose to dey tish odas. Instead, una still wont make pesin kom tish una di first tin wey dey God word. Una still dey drink milk, instead of una to dey chop solid food.


Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!


So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”


Den di angel tell mi, “Pipol fit trust dis word bikos na true. God wey bi di profets spirit Oga God, don send en angels kon show en savants wetin go soon happen.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ