Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 3:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 3:19
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E dey give hope to di poor kon silent wiked pipol.


Wen pipol wey dey obey God si all dis tins, dem go happy, while wiked pipol go shut up dia mout.


But di king go happy bikos of God love. Evribody wey trust God go dey boast, bikos pipol wey dey lie, go shut up forever.


I go forgive yu all di bad tins wey yu don do, but wen yu remember dem, shame nor go let yu open yor mout.” God wey get pawa don tok.


All dis tins happen, so dat wetin God law tok, go bi true sey, ‘Dem nor get rizin to take hate mi.’


Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey komot for der one-by-one. Na di old pipol first start to komot, till e remain only Jesus and di woman wey stand for en front.


From di time wen God kreate di world, E don show us di tins wey ordinary eye nor dey fit si; E show us en pawa and life thru di tins wey E kreate. So wiked pipol nor get eskuse at-all.


E really dey good to sekonsaiz pesin! And wi know sey na Jew pipol God first give en message.


Evribody don sin and wi don fall komot from God glory,


Even doh evry human being dey lie, God nor fit lie. God word sey: “Make yu dey tok wetin bi trut; so dat yu go fit win yor kase wen dem dey judge yu.”


So wetin wi go tok? Wi go sey na wi wey bi Jew betta pass? Dat na lie! Bikos as I don already show una, Jew and Gentile pipol dey kommit sin.


God do like dis, so dat nobody go fit boast for en front.


Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.”


Make una tell mi, wish of una won dey under di law? Una nor know wetin di law tok?


make e save pipol wey dey under di law, so dat God go make us en own shidren kon give us awa own propaty.


But if una allow di Spirit kontrol una, den una nor dey under di law again.


E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ