make Yu listin from heaven kon judge di kase. Make Yu ponish di pesin wey dey guilty, den free di one wey dey innocent and make Yu reward di two of dem akordin to wetin dem do.
Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue with am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, “Naim bi sey God don give Gentile pipol di shance to take turn from sin kom meet am, so dat dem go get di life wey nor dey end.”
So my brodas, wey bi Abraham shidren and una wey bi Gentile pipol wey dey fear God, na di message about how God go take save pipol, naim wi kom tell una so.
but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.
Afta three days, Paul koll all di Jew pipol oga dem togeda. Wen dem don gada, e kon tell dem, “My pipol, even doh I nor do anytin against awa pipol or awa grand-grand papa dem tradishon, from Jerusalem naim dem turn mi to prisona kon karry mi give Rome pipol.
For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.