doz wey bi leaders for Ammon kon tell di king, “Yu tink sey na bikos of yor papa wey die naim make David send dis pipol kom? Wi bilive sey e send dem kom spy di land, so dat e go kom fight and win us leta!”
But Judah king go against Babilon king. E go hire horse and many sojas from Egypt. Naw, with all dis one, e go fit win di fight against Babilon king? E go fit do wetin e plan? E go fit break di agriment and nobody go ponish am?
E sey, “Make yu nor fear, God love yu well-well! So nor let anytin worry yu. Make yu dey strong! Wen e don tok like dis, my body kon strong more-more.” Den I sey, “Oga! Yu don make mi dey okay naw.”
Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef.
But, my friend, I dey ask, “Who yu tink sey yu bi, wey make yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, ‘Why yu dey mold mi like dis?’ ”
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.
Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?