25 Sekonsishon get value only if yu dey do wetin di law tok, but if yu nor dey obey di law, yu and di pesin wey dem neva sekonsaiz na di same.
Make una keep di kovenant wey una make with mi wey bi una God kon dedikate unasef to mi. If una nor do am and una kontinue di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire. E go burn well-well and nobody go fit kwensh am.”
“Si how una sturbon! Just as una grand-grand papa dem bi, na so una still bi too, bikos una don make una heart strong to disobey God!
Bikos yu dey hear di law nor mean sey yu good for God eye, but na wen yu do wetin di law tok.
Yu wey dey take di law boast, yu dey bring shame to God name, bikos yu dey disobey di law!
So if Gentile pipol wey dem nor sekonsaiz dey obey evritin for di law, yu nor tink sey God go take dem as pipol wey dem sekonsaiz?
Yu nor know sey di pesin wey dem nor sekonsaiz go judge yu wey bi Jew, since yu dey break di law?
Pesin nor bi Jew bikos of wetin pipol si from outside. Di really sekonsishon nor bi wetin pipol dey si,
Weda dem sekonsaiz yu or not, nor mean anytin. Wetin dey important, na to obey God law.
Pipol wey sekonsaiz nor dey obey di law, but dem wont make una sekonsaiz, so dat dem go fit use una take boast.
Weda pesin sekonsaiz or not, e nor mean anytin, di only tin wey matter bi sey, una don turn to new pesin.
Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life.