God ask, “Jerusalem pipol! Wetin nor go make mi ponish una wen e bi sey, una leave mi kon go woship gods wey nor bi god at-all? Even doh I dey give una evritin wey una wont, una still dey bihave like wife wey go sleep with who nor bi en husband and una dey stay with ashawo.
Curse dey di pesin head wey dey play wayo and offa yuzles animal, wen e bi sey e get many betta animals wey e promise sey e go give mi! I bi strong king and all di nashon dey fear mi.”
Una tink sey e nor dey bad to offa animal wey blind and dey sick as sakrifice to mi? Make una try give dat kind animal to una govnor, weda e go happy or give una anytin wey una ask from am.
E dey good for pesin to shit God? No! But una dey shit mi and una dey ask, ‘How wi take dey shit Yu?’ Na for di matter wey koncern una ofrin and one out of evry ten tins wey una get.
Una wey dey do bad tins for dis world, una nor know sey to bi dis world friend, mean sey una bi God enemy? So anybody wey gri sey en and dis world na friend, don make ensef God enemy.