Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 2:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 and yu dey tish foolish pipol and small shidren wey nor know anytin, bikos yu know sey, di trut and evritin wey man nid to know, dey for di law.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 2:20
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.


Yu dey show blind pipol road and dey help doz wey dey for darkness si lite,


So make wi trowey di law bikos of faith? No way! E nor go work! Instead, wi go make di law strong well-well.


But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.


My brodas and sistas, wen I dey with una before, una dey bihave like pipol for dis world. Na dis make mi nor fit tok to una as pipol wey get God Spirit. Dat time, una faith for Christ bi like small pikin own.


Make yu kontinue with di word wey I tell yu kon dey do am with di faith and love wey dey inside Christ.


If yu look dem well-well, dem bi like God pipol, but dem don rijet God pawa. So make yu run from dis kind pipol.


Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.


Anybody wey still dey drink milk, bi like small pikin wey nor know good from bad.


My brodas and sistas, evribody nor go fit bi tisha, bikos yu know sey wi wey dey tish, na awa judgement go big pass,


But make una dey hongry for spiritual milk like pikin wey dem just born, so dat una faith go strong well-well


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ