Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 2:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 2:1
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But Jesus ask am, “My friend, na who make mi judge for una two matter?”


“Di oga kon tell am, ‘Na yor word I go take judge yu, yu wiked savant! So yu know sey, I bi hash man; dey chop food wey nor bi my own and I dey plok fruit wey I nor plant?


“Make una nor judge oda pipol, so dat God nor go judge una. Make una nor kondemn odas, so dat God nor go kondemn una. Make una forgive odas and God go forgive una.


Anytin wey yu bilive about dis matter, make yu keep am to yorsef and God wey dey heaven, dey si am. God don bless di pesin wey nor kondemn ensef, bikos of wetin e do.


Wi know sey God nor dey lie wen E dey judge pipol wey dey do bad tins.


Yu wey dey do tins wey yu sey make odas nor do! Yu tink sey yu go eskape God judgement?


So wetin wi go tok? Wi go sey na wi wey bi Jew betta pass? Dat na lie! Bikos as I don already show una, Jew and Gentile pipol dey kommit sin.


But, my friend, I dey ask, “Who yu tink sey yu bi, wey make yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, ‘Why yu dey mold mi like dis?’ ”


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


Yu wife! How yu take know sey yu nor go fit save yor husband? Yu husband! How yu take know sey yu nor go fit save yor wife?


Foolish man! Yu wont make I show yu sey faith wey nor get work dey yuzles?


My brodas and sistas, make una nor tok bad about each oda. Anybody wey tok bad or judge en broda or sista for Christ, e dey tok bad about di law and e dey judge di law. But if una judge di law, den una nor dey obey di law, but una don bikom di law judge bi dat.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ