Make una still help mi salot di pipol for di church wey dey meet for dia house. Salot Epaenetus, my good friend (di first pesin to bilive Christ for Asia).
Make una greet my kousin Andronikus and Junia wey dey prison with mi before. Di apostles dey respet dem and dem too don dey follow God, before I even know Christ.
Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.