Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 16:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 I dey happy, bikos evribody don know how una dey obey God. But I wont make una dey wise wen e rish matter wey koncern wetin dey good or bad. Make una nor do any bad tin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 16:19
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make Yu help mi to do di rite tin, so dat I go dey honest and dey do good as I dey rule my kingdom.


But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”


“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.


Make una go! I dey send una like small-small sheep go meet wiked animal.


Today, I tank my God thru en pikin Jesus Christ for all of una, bikos na for di whole world dem dey tok about how una faith for God strong rish.


My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.


Bikos of dis, make una get sense to undastand wetin awa Oga God word tok and mean.


I pray make una love dey strong more-more for God tins wey una learn and make E help una undastand,


so dat una nor go get any blame and una go dey klean. God Pikin nor get fault; even doh una dey live for di world wey bad pipol dey, una go dey shine like stars,


Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ