Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.
But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut.
Mi wey bi elder dey rite dis leta to di woman wey God choose, with en shidren wey I love inside di trut (nor bi only mi, but na evribody wey know di trut).