9 so dat Gentile pipol go praiz God sey e dey good to dem. Just as God word sey, “I go tell Gentile pipol about yu and I go sing, dey praiz yor name.”
So, I dey praiz Yu among all di nashon; I go sing praiz Yu.
Bikos of dis, I go praiz God among di nashons; I go sing praiz to en name.
I go tank Yu wey bi my God for where evribody dey. I go sing yor praiz among all di nashons.
Wen di pipol si wetin happen, fear katch dem well-well and dem kon bigin praiz God wey give dis kind pawa to human being.
As for una wey bi Gentile pipol, una don disobey God before, but naw, God don sorry for una, bikos Jew pipol nor gri obey am.
Abi na only Jew pipol God dey dia side? E nor dey Gentile pipol side too? True-true, God dey Gentile pipol side.