Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 15:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Make I tell una di trut, Christ kom as Jew pipol savant to show sey, God don keep di promise wey E make with dia grand-grand papa dem. Christ still kom,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 15:8
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wetin I dey tok so, na trut; bikos I nor dey lie.


Just as Yu promise awa grand-grand papa, Abraham and Jakob, na so too Yu go show us yor faithfulnes and love wey nor dey fail.


Jesus kon tell di woman, “Na di sheep wey lost among Israel pipol, naim God send mi kom find.”


just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”


E kom meet en own pipol, but dem nor wont am.


I get oda sheep wey nor dey here. I must gada dem too and dem go listin to my vois, all of dem go dey togeda and na one shepad go lead dem.


Paul and Banabas kon use boldness take ansa dem, “E good sey na una wi first prish God word give. But since una rijet am and una nor ready to get life wey nor dey end, wi go-go prish give Gentile pipol.


Naw, una don si how God dey good and harsh. Even doh E dey vex for doz wey fall, E still dey kind to una. And E go always dey kind to una, as long as una dey do wetin E wont. If not, E go rijet una too.


As for una wey bi Gentile pipol, una don disobey God before, but naw, God don sorry for una, bikos Jew pipol nor gri obey am.


naim make am choose mi to bi Jesus Christ savant for Gentile pipol and make I for dey prish di Good News. Dis tin happen, so dat di Holy Spirit go make God dey happy with Gentile pipol.


Dis still show sey God dey rite wen E asept pipol wey bilive Jesus Christ. E dey ponish sinnas, so dat wi go know sey en na God wey nor like sin. Like dis, God show sey en dey rite and anybody wey bilive Jesus Christ, E dey make dem dey rite too.


But wot if some for dem nor gri bilive? Dat mean sey God dey lie?


Na dis one make God promise dey kom by faith and wi dey get am thru favor. Nor bi only pipol wey dey obey di law bi Abraham shidren, but pipol wey bilive God like Abraham, naim en shidren dem bi too, bikos na Abraham bi awa spiritual papa.


Wetin I hear bi sey, some of una dey sey, “Na Paul side I dey” odas sey, “Na Apollos side I dey” some still sey, “Na Pita side I dey” or “Na Christ side I dey.”


I nor dey sey juju food or di one wey dem sakrifice mean anytin.


I nor mean yor konscience, but di oda pesin own. So bikos of wetin anoda pesin dey tink, I nor go fit do wetin I wont do?


My friends, I wont make una know sey awa body wey get blood go rotin. Dat mean sey dis kind body, nor go fit enter God kingdom wey go dey forever.


And evritin wey God promise us, na “Yes” thru Jesus Christ. Dat na why awa “Amen” thru Jesus Christ dey give God glory.


Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ