Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 15:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 so dat as una dey togeda, una go fit use one vois praiz God, wey bi awa Oga God Jesus Christ, Papa.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 15:6
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una know sey, for dat time, I go make di nashons praiz mi well-well. All of dem go dey pray with my name kon woship mi with one spirit.


I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”


Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”


Wen dem hear wetin happen, dem kon pray to God sey, “God wey dey for heaven, yu wey make heaven, eart, di sea and evritin wey dey inside dem.


All di pipol wey bilive Jesus Christ kon dey do tins togeda with one mind and nobody sey e go use wetin e get for ensef alone, so dem kon dey share dia propaty togeda.


Make wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, di God wey dey give mesi and konfort,


God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, wey dem go praiz forever, know sey nor bi lie I dey tok.


I pray make God, awa Oga God Jesus Christ Papa wey get glory, give una spiritual wisdom and revelashon, wey go make una know am well-well.


I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.


Wi dey always tank God wey bi Jesus Christ Papa, anytime wen wi dey pray for una,


Wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, for di mesi wey E dey show us. God give us new life thru Jesus Christ wey E wake from deat and naim bi di Pesin wey give us hope.


di one wey give us betta kingdom kon make us priest wey go dey serve God wey bi en Papa, make glory and pawa bi en own forever and ever! Amen.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ