4 Bikos evritin wey dem rite from biginnin, na to tish, enkourage and give us hope.
So, make una rite dis tin down for una shidren-shidren, so dat wen dem born dem, dem go praiz God.
Yor promise dey revive and help mi wen I dey for trobol.
So God ansa: “Di vishon wey I dey tell yu naw, make yu rite am down make e klear, so dat anybody wey read am, go undastand am well-well.
Make una let una hope give una happiness. Make una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray.
Dem rite dis tins wey happen to dem to tish us lesin and na ezample for doz wey go dey wen di world go end.
Wi remember di work wey una don do thru faith and as una dey bear bikos of di hope wey una get about awa Oga God Jesus Christ.
So, make una always dey ready for akshon. Make una shine una eye and put hope for di grace wey Jesus Christ go bring.