Dia curse dey pain and e dey make my heart kut; I dey look for who go tell mi sorry, but I nor si. I dey find who go konfort mi, but I still nor si anybody.
E good make disciple bi like en tisha and savant bi like en oga. If dem dey koll oga for en house ‘Belzibub (wey mean demon oga),’ wot of di pipol wey dey di house? Dem nor go koll dem bad name too?”
E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”
If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa.
I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.