29 And I know sey wen I kom visit una, I go bring plenty blessings from Christ kon give una.
Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.
I go bless dem kon let dem stay near my holy hill and for der, I go bless dem with betta rain anytime wey dem wont am.
Afta all dis tins happen, Paul kon sey e go-go Jerusalem thru Masidonia and Akaia. E plan sey, “Afta I don rish der, I go still go Rome.”
But naw, nor-tin remain wey I go do for dis part for di world again and e don tey wey I dey plan to kom visit una.
Make una pray give God, so dat I go kom visit una with happiness.
Na with dis mind I bi won take kom meet una before, so dat wi go bless una again.
I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.
Den una go really know di love wey Christ get, wey big pass evritin wey una go fit undastand and evritin inside God, go full una life.
Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.
so dat wi go bi one for di tins wey wi bilive and wey go make us really know God Pikin. Den, wi go dey tink like Christ.