Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 15:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 bikos God pipol for Masidonia and Akaia give mi money make I give di poor Christians for der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 15:26
33 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na sin for yu nor to respet yor neighbour, but doz wey dey help poor pipol, na blessing go follow dem.


Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.


If yu dey laf poor pipol, den yu dey curse God wey kreate dem, so pesin wey dey happy sey odas fall, God go ponish am.


I kansol di kovenant dat same day. Di pipol wey dey buy and sell di sheep dey look mi and dem know sey God gri with evritin wey I dey do.


Na pipol wey dey buy and sell di sheep, hire mi and I kon turn shepad wey dem won go kill en sheep. I take two stik kon koll one, “Favor” and di oda one na, “Unity.” So I kon dey kare for di sheep dem.


“Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’


Poor pipol dey with una evritime, but mi, I nor go dey with una always!


Instead wen yu dey do big party, make yu invite poor pipol, pipol wey dia leg or hand kut komot, pipol wey nor fit waka and pipol wey nor dey si.


Den Jesus look en disciples, tell dem, “Make una happy, una wey dey poor, bikos na una get God Kingdom.


and from der, to Filippi wey bi nomba one town for Masidonia, wey Rome dey rule. Wi stay for dis town for some days.


Paul si dis vishon for nite: One man wey kom from Masidonia stand dey beg am sey, “Make yu kom help us for Masidonia!”


Wen Gallio dey rule for Akaia, Jew pipol join togeda attack Paul kon karry am go di judgement seat.


Afta all dis tins happen, Paul kon sey e go-go Jerusalem thru Masidonia and Akaia. E plan sey, “Afta I don rish der, I go still go Rome.”


But Ananias ansa, “Oga God, many pipol don tell mi about dis man and all di wiked tins wey e don do to yor pipol for Jerusalem.


Una know sey na Stefanas and en family first bilive God for Akaia. Dem don do evritin wey dem fit do for God pipol. My friends, I wont make una


And afta I don finish for Masidonia, I hope to kom si


Bikos I plan to visit una wen I dey go Masidonia and wen I dey kom back, so dat una go help mi wen I dey travel go Judea.


Wen I nid anytin for di time wen I dey with una, I nor put my load for anybody head, bikos awa brodas wey Masidonia dey give mi evritin wey I nid. I nor allow mysef to bi problem for anybody and I nor go ever do am.


my mind nor rest, bikos I nor si awa broda, Titus, for der. So I leave der kon go Masidonia.


Even wen wi enter Masidonia, wi nor rest at-all, but dem trobol us from difren korna; wahala for outside, fear for inside.


Bikos dis work wey una dey do so, nor just dey help only God pipol, but e dey always make pipol, tank God.


bikos I know sey una one help dem. I always dey boast give Masidonia pipol sey, una wey dey Akaia, dey always won help and una don ready to give money since last year. And di way wey una dey won help, don make some for dem won help too.


But if anybody for Masidonia follow mi kom meet una, den e si sey una neva ready to give, shame go katch us, (I nor go tok too mush) bikos wi trust una.


Filippi pipol, una know sey, wen I komot from Masidonia, for di time wen I just start to prish di gospel, na una bi di only church wey help mi and na only una dey follow mi share for my happiness and sofa.


So una bi ezample to all di pipol wey bilive Jesus for both Masidonia and Akaia.


Bikos nor bi only sey di message about Christ don rish evriwhere for Masidonia and Akaia, but dem don hear di news about una faith for evriwhere. So wi nor even nid to tok about una again.


And una really dey show love to di Christian brodas and sistas for Masidonia. My brodas and sistas, wi dey beg una sey, make una kontinue to dey do like dat.


As I tell yu wen I dey go Masidonia, make yu korrect doz pipol for Efesus wey nor dey tish di trut


bikos I don hear about di faith and love wey yu get for awa Oga God Jesus Christ and all God pipol,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ