25 But naw, I dey take message go give God pipol for Jerusalem,
but e tell dem bye-bye kon sey, “If God wont, I go kom again kon si una.” Den e enter ship from Efesus
Afta all dis tins happen, Paul kon sey e go-go Jerusalem thru Masidonia and Akaia. E plan sey, “Afta I don rish der, I go still go Rome.”
Paul don sey e go travel pass Efesus make e for nor spend time for Asia, bikos e dey hurry make e for kwik rish Jerusalem for Pentekost Day.
Naw, di Spirit dey lead mi go Jerusalem, even doh I nor know wetin go happen to mi for der,
Afta many years, I kom Jerusalem back kon give gift to poor pipol and offa sakrifice.
But Ananias ansa, “Oga God, many pipol don tell mi about dis man and all di wiked tins wey e don do to yor pipol for Jerusalem.
Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.
But if una sey make I go too, den, dem go follow mi go.
and dem dey beg us make wi let dem do am, so dat dem go get di blessing wey dey follow pipol wey dey give.
Na dis make us beg Titus sey, as e don start, e good make e finish dis good work wey e dey do, bikos e love una.
But dem sey make wi always remember poor pipol and na wetin dey my mind to do, bi dat.
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.