Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 15:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 I go plan to stop si una wen I dey go Spain, so dat una go help mi for di journey, afta I don stay with una for sometaim.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 15:24
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu nor dey too visit yor neighbour, bikos dem fit taya kon hate yu.


So di church send dem go and as dem dey go, dem pass Foenicia and Samaria kon tell pipol wey dem meet for der how Gentile pipol take turn from dia sin kom meet God and di story make all di brodas wey hear am, happy well-well.


Afta all dis tins happen, Paul kon sey e go-go Jerusalem thru Masidonia and Akaia. E plan sey, “Afta I don rish der, I go still go Rome.”


Wen wi don stay der for sometaim, wi kon travel komot der. All of dem with dia wife and pikin escort us go outside di town. Wi knee down pray for di wotaside


den mi and una go dey happy and Jesus Christ wey wi bilive, go give us rest for awa mind.


So, afta I don finish dis work kon dey sure sey di bilivers don get dia blessings for Jerusalem, I go visit una wen I dey go Spain.


Bikos I plan to visit una wen I dey go Masidonia and wen I dey kom back, so dat una go help mi wen I dey travel go Judea.


Dem don even tok about yor love for inside di church where God pipol gada. E go good sey wen dem kom yor side, make yu help dem, so dat belle go sweet God as dem dey kontinue dia journey.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ