23 But naw, nor-tin remain wey I go do for dis part for di world again and e don tey wey I dey plan to kom visit una.
Afta all dis tins happen, Paul kon sey e go-go Jerusalem thru Masidonia and Akaia. E plan sey, “Afta I don rish der, I go still go Rome.”
And I know sey wen I kom visit una, I go bring plenty blessings from Christ kon give una.
Make una pray give God, so dat I go kom visit una with happiness.
Wi dey pray with all awa mind for day and nite sey, make God let us si una again kon let una know evritin wey una suppose know about una faith.
Wen I remember as yu take kry, e dey hongry mi to kom si yu, so dat joy go full my mind.