23 But if yu dey doubt wetin yu chop, den yu dey kondemn yorsef and yu know sey dat nor good, bikos anytin wey yu do against wetin yu bilive, na sin.
So anybody wey dey disobey dia ruler, dey disobey God and God go ponish am.
Some pipol tink sey one day betta pass anoda and some tink sey, evriday na di same. But make evribody bilive wetin dem won bilive.
Nor bi evribody know dis tins. Some pipol don grow with di bilive sey juju dey alive. So wen dem dey chop meat wey dem give juju, dem go dey fear.
Evritin dey pure to doz wey dia heart dey pure. But nor-tin dey pure to doz wey bad tins full dia mind.
Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si.