Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Romans 14:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Anytin wey yu bilive about dis matter, make yu keep am to yorsef and God wey dey heaven, dey si am. God don bless di pesin wey nor kondemn ensef, bikos of wetin e do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Romans 14:22
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na bikos of dis I dey always try my best to get klean belle for God and pipol front.


As I don know Christ, e don make mi know sey all food dey klean. But if yu tink sey e nor good make yu chop some food, dat nor mean sey, e nor good for anoda pesin.


Some pipol tink sey e dey rite to chop any food and odas wey dia faith dey weak, dey chop only vegitabol.


But if yu dey doubt wetin yu chop, den yu dey kondemn yorsef and yu know sey dat nor good, bikos anytin wey yu do against wetin yu bilive, na sin.


Some pipol tink sey one day betta pass anoda and some tink sey, evriday na di same. But make evribody bilive wetin dem won bilive.


Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef.


I nor undastand wetin I dey do; bikos I nor dey do wetin I won really do. Instead na wetin I nor like, I dey do.


I nor dey happy at-all! Who go save mi from dis body wey dey push mi go die?


Nor bi evribody know dis tins. Some pipol don grow with di bilive sey juju dey alive. So wen dem dey chop meat wey dem give juju, dem go dey fear.


Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.


My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too.


Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.


My friends, if awa mind nor kondemn us, awa heart go strong for God present


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ